Translate

Federal Government Grant: State Social Register Might Be Used To Share ₦50,000 To Help 100,000 Households Across Nigeria

President Bola Ahmed Tinubu don direct di sharing of money to plenty plenty families for di thirty six states of Nigeria as part of goment effort to reduce di hardship wey pipo dey face.

For di National Economic Council meeting on Thursday, di presido Bola Ahmed Tinubu tok say goment go distribute "₦50,000 uplift grant each to 100,000 families per state for three months".

Dat na ₦5,000,000,000 per state, ₦185,000,000,000 for di thirty six states plus FCT, and ₦555,000,000,000 for di three months.

Dis project follow for a new 'National Construction and Household Support Programme' wey Presido Bola Ahmed Tinubu tok say im administration dey kickstart.

Di programme go also include "deployment of ₦155,000,000,000 to buy and sell assorted foodstuff wey goment go distribute across di nation".

Oda tins wey follow for this support programme wey federal goment wan start na:

Federal Government go give states and FCT ₦10,000,000,000 each to buy CNG buses for mass transit to reduce transportation cost.

Goment go make provisions for Labour and Civil society organisations. E neva dey clear wetin dis provisions go be

Goment go do fast fast construct di Sokoto-Badagry Highway, wey go connect Sokoto, Kebbi, Niger, Kwara, Oyo, Ogun, and Lagos. Dis na sake of easy transportation of food produce from di north to di western parts of Nigeria

Bola Ahmed Tinubu also approve money to complete di Port Harcourt-Maiduguri Railway; wey connect Rivers, Abia, Enugu, Benue, Nasarawa, Plateau, Bauchi, Gombe, Yobe and Borno

How goment go select families wey go benefit for the federal government grant?

Di statement wey Ajuri Ngelale, di toktok pesin for President Bola Ahmed Tinubu, bin release, no get clear explanation about how dem go choose families.

Oga Ajuri Ngelale no dey reachable wen BBC Pidgin call am for more explanation on Friday. E no also reply message wey we send am.

Dis no be di first federal government grant wey Presido Bola Ahmed Tinubu dey share to poor pipo and households. For 2023, Presidio Bola Ahmed Tinubu announce one 'Conditional Cash Transfer' programme.

E say goment go dey pay ₦8000 evri month give 12,000,000 poor and low-income households for a period of 6 months.

Dat time, to qualify for di conditional cash transfer scheme you must fulfil certain conditions.

Goment say di moni na for pipo wey dey earn less dan $1.95 or N1500 in a day, and di names of pipo wey fall under dat bracket dey inside di National Social Register.

Na informate from dat register goment go use pay pipo di money.

But for inside di statement on Thursday, Presido Bola Ahmed Tinubu tok say "states must work together to deliver on di critical reforms required of us to meet di needs of our people".

During di time of President Muhammadu Buhari, e start a program - National Social Safety Nets Project - wey create a 'National Social Register'.

Dis national social register get information about pipo wey go dey benefit from goment social assistance programs across all di states and di FCT; and by di time Buhari tenure finish, goment tok say di list contain over 16,000,000 households, and more dan 61,000,000 vulnerable pesin wey don register.

Na di national social register Federal Government bin take dey pay poor pipo ₦5000 every month for di conditional cash transfer project wey Buhari bin start.

However, two months afta Presido Bola Ahmed Tinubu take ova, in July 2023, di National Economic Council - wey get all di state govnors as members - tok say dem no go use dat social register again sake of say e no dey credible.

Anambra State govnor, Chukwuma Soludo bin tell tori pipo dat time say NEC agree make states come up wit dia own registers "using formal and informal means".

So di state social registers fit be one of di options to use for di disbursement of di ₦50,000 federal government grant to di housholds wey go benefit.

Source: https://www.bbc.com/pidgin/articles/cw0y57jnd8wo

Comments

Popular Posts